WebNovelCommotion23.53%

Movement 1:2

Customer 1: Ask the leaders, not me. It is only the prices of survival that increases, not our salaries. My wife and I put our salaries in the kitty just to put food on a single table. Now, a bag of common rice worth more than my wife's salary.

Trader 1: You are even so lucky you earn salaries; imagine, the both of you. Take a look at me, I am a sound university graduate; no job. That's why I'm here booing and yelling with these Mr and Mrs Does.

Trader 3: A.B.C! Amebo Business Centre. Make una no carry una yeye gossip dey reach my shop, tufikwa. Make una dey watch boundary oh; me, I no get time for ngbanti ngbanti.

Mama Chika enters with a piece of wrapper tied around her chest. She enters from downstage left carrying a tray pan of vegetables. Chika walks behind her carrying a bucket of water.

(Mama Chika: Eh! Eh! Mallam, wetin you dey do for my space? (Drops the tray pan on the ground furiously)

Trader 4: I tell am oh. I tell am say na Mama Chika get that space.

Mama Chika: Mallam, na you I dey follow talk oh.

(Mallam Sanni stops cutting the meat apart)

Mallam Sanni: Madam, na me get am for this place. And make I talk am now, my name no be mallam. My name na Sanni or oga Sanni.

Mama Chika: Sanni, abi mallam, wetin be the difference? Biko, pack your load comot for my space.

Mallam Sanni: Madam, comot for here; make I no wound you oh.

Mama Chika: Oh! You go wound me kwa? (she unites the piece of wrapper and ties it on her waist) You think say na only you be man eh? I go show you say I get man like you for house. Chika wait me here, make I go bring your papa come. (She dashes of the scene)

The orchestra sings song 2.