NINE: BATTLE OF WITS AND MUSCLES

‘... Yes, Skull, we're about to make a move and the situation no look positive, but we gats do something fast, or the guy fit die before backup arrives.’

'Do wetin you fit do but dey careful, I don alert boys wey dey near you and they go help una escape. Don's boys don dey mobilize too, dem go seal the area. Remember, anything you do, use your brain and no die.'

'Alright boys, I don contact Skull and the thing we need do nah to snatch our client, escape from here, and survive for a few hours before Skulls guys go reach our side.'

'How we wan take burst this guy comot for here now? We no go fit take Scorpio and the Dagger brothers head on o!' Ibramovic asked while cradling a dagger he got at Don's place.